By: Rilwan Agbomeji
Chelsea Oga, Enzo Maresca don open mouth say Cole Palmer dey fit and ready to jam Leeds United for Elland Road dis Wednesday wey dey come.
Maresca yarn say Palmer dey try gain im full fitness back, but di plan na to push am small-small until e fit run full 90 minutes like before. Di coach add say everybody dey okay, but Romeo still dey recover and Dario wey just start training don slow down again, so dat marras no go worse again pass before.
Chelsea dey unbeaten for six straight games, as dia unbeaten run straight pass ruler, dem dey reason make Leeds no spoil dia shine.