Sports

673 Results / Page 36 of 75

Background

Sports

Ighalo Talk Am Clear – Osimhen Suppose Carry Super Eagles Captain Band

By: Rilwan Agbomeji Former Super Eagles hitman, Odion Ighalo, don drop am hot say Victor Osimhen na di right man to wear Super Eagles captain band. Dis talk come afta ex-captain, William Troost-Ekong, comot from international football. Though many people dey shout Wilfred Ndidi name, Ighalo say Osimhen get di fire, form and liver to lead di team. According to am, Osimhen dey ball well and no dey fear to […]

todayDecember 18, 2025 13

Sports

Super Eagles Jim Jim Bodi For Cairo, 12 Players Still Dey Load

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles don kick off dia Cairo mission, as dem go hold first official training on Monday evening, after more players don touch camp ahead of di international match, Training go start 8:00pm local time for main bowl of Cairo International Stadium, with coach Eric Chelle and im technical crew dey ready to drill di boys. As at Monday morning, 11 players don report for Renaissance Hotel […]

todayDecember 15, 2025 34

Sports

Alcohol, Animals, Other Items No Dey Allowed Inside AFCON 2025 Stadiums

By: Rilwan Agbomeji As AFCON 2025 dey near, wey go start December 21 for Morocco, CAF don release list of items wey no go allow for all stadiums. Dem put di rules for dia website on Monday, talk say na to keep fans safe throughout di tournament. Everybody wey wan attend AFCON matches for Morocco go need pass security screening before dem fit enter stadium. Di guideline dey make sure […]

todayDecember 15, 2025 25

Sports

Lookman, Ajayi, Osayi-Samuel Reach Super Eagles Cairo Camp

By: Rilwan Agbomeji Atalanta winger Ademola Lookman,  defenders Semi Ajayi plus Bright Osayi-Samuel don touch Super Eagles camp, Cairo, to jim jim di bodi ahead of AFCON 2025. Fresh faces like goalkeeper Amas Obasogie, Tochukwu Nnadi, and Igoh Ogbu also don report for duty, ready to join di squad. Dem join forces with Francis Uzoho, Stanley Nwabali, Ebenezer Akinsanmiro, and Fisayo Dele-Bashiru, wey don already dey camp. With everybody now […]

todayDecember 15, 2025 13

Sports

NFF Call For Sponsors To Bring Video Assistant Referee To NPFL

By: Esther Ayoola Nigeria Football Federation (NFF) don clear mata say dem nor hapi with how referees dey do their work for Naija football leagues, after Nigerian refs miss chance to officiate 2025 Africa Cup of Nations (AFCON). NFF tuk this one after dem Executive Committee meeting wey hold for Abuja, dey call on senior mhen make dem con sponsor video assistant referee doings for the NPFL. Confederation of African […]

todayDecember 15, 2025 7

Sports

Slot Say Im Sti Want Salah For Liverpool

By: Rilwan Agbomeji Liverpool manager, Arne Slot say  liverpool marraigae with Salah never sti finish normal, and that im go sit down Salah tuk mata as e dey be. U sabi say Salah, wey be 33 years old, vex say dem leave am out of di Champions League game against Inter Milan afta Liverpool draw 2-2 for Leeds, and e complain say e dey throw under di bus by di […]

todayDecember 12, 2025 25

Sports

Udeze Question Super Eagles Final Squad For AFCON 2025

By: Rilwan Agbomeji Former Super Eagles star Ifeanyi Udeze don talk say di final 28-man squad wey Nigeria release for AFCON 2025 get many questions wey never receive answer. Di final list drop on Thursday and e spark plenty debate for football circles. Nigeria pick three goalkeepers, eight defenders, eight midfielders and nine forwards for di tournament. Udeze say di selection still raise eyebrow and Nigerians deserve clearer justification.  

todayDecember 12, 2025 22

Sports

Super Eagles Coach Chelle Drop Im Final 28-Man Squad For 2025 AFCON

By: Esther Ayoola Super Eagles coach, Eric Chelle, don announce him final 28-man squad for 2025 Africa Cup of Nations wey go hold for Morocco from December 21, 2025, reach January 18, 2026. Di team get three goalkeepers, eight defenders, eight midfielders, and nine strikers. Big names wey no make di final list include Udinese goalkeeper Maduka Okoye and Wolverhampton striker Tolu Arokodare, but Francis Uzoho and Paul Onuachu don […]

todayDecember 12, 2025 13

Sports

Super Falcons Fall Enter 37th For FIFA Ranking

By: Rilwan Agbomeji According to report say Super Falcons don drop enter 37th position for latest FIFA Women World Ranking. FIFA release di new ranking on Thursday, and di Falcons no play any match during di last international break. Dem bin before dey 36th position for di world. Even with di drop, Naija still dey hold number one spot for Africa.  

todayDecember 11, 2025 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app