Sports

673 Results / Page 37 of 75

Background

Sports

Victor Osimhen Collobi Turkey Sportsman Of The Year Award

By: Alice Iduh Galatasaray striker Victor osimhen based on betterlicoius doings don win sportsman of di year award for turkey for 2025 gq türkiye men of di year awards. Di nigerian forward help galatasaray win plenty matches last season as e score 37 goals and give 7 assists across all competitions. Osimhen wey dey 26 years old, don still dey fire this season with 11 goals in 14 games.

todayDecember 11, 2025 17

Sports

Super Eagle Legend Babangida Sama Message Give Coach Chelle To Arrange Beta Team For AFCON

By: Rilwan Agbomeji Former Naija winger, Tijani Babangida don tier better warning, role am, package am, give wi Super Eagles coach Eric Chelle say, make e no base di team only on striker Victor Osimhen for di 2025 Africa Cup of Nations for Morocco. Na for tuk tuk session with tori pipo on Wednesday, Babangida dey talk dis one,  say e dey risky as Naija dey depend too much on […]

todayDecember 11, 2025 15

Sports

Heartland Coachie Amuneke Vow To Show Sunshine Stars Peper For Akure

By: Rilwan Agbomeji Di fight for promotion don dey heat up for wi national league, say heartland technical adviser, Emmanuel Amuneke don yarn full ground say im team go put body make dem win against sunshine stars. Di naze millionaires dey ready for Nigeria National League, NNL, matchday five wey go hold for Akure today Wednesday. Last weekend, Heartland beat Inter Lagos 3-2 for dan Anyiam Stadium, Owerri. Amuneke dey […]

todayDecember 10, 2025 12

Sports

NFF Promise To Pay Super Eagles Coachie Im Three Month Gbese Ahead Of AFCON 2025

By: Rilwan Agbomeji Unto matter for sport, Nigeria Football Federation don comout clear fans doubt say dem go pay di Super Eagles coachie, Eric Chelle, salary wey dem owe am before di 2025 Africa Cup of Nations for Morocco. NFF top official talk say, dem dey owe di franco Malian Coachie Chelle three months salary plus bonuses, and dem wan pay am make e fit prepare di team wella. Di […]

todayDecember 10, 2025 14

Sports

Mbappe Wunjury Shake Real Madrid Ahead City Clash

By: Alice Iduh Real madrid french superstar kylian mbappe no show for training on tuesday as them dey prepare for big champions league clash against manchester city on wednesday. According to report, di 26-year-old striker weh don score 25 goals for 21 matches this season, break him finger for la liga match against celta vigo on sunday and e get other wahala wey dem sti dey treat for sick bed. […]

todayDecember 9, 2025 10

Sports

Rivers United Coach Express Cocern As Im Team Play Draw With Abia Warriors

By: Alice Iduh Rivers United coachie Finidi George don scatter im mouth UNTOP IM players players dat, dem   need change their mentality after dem concede late goal wey make dem draw Abia Warriors for NPFL match on Sunday. Maclyn Biokpo score for Rivers United for 86th minute, but Suraj Lawal score for Abia Warriors deep inside stoppage time to make am draw. Finidi complain say him team give Lawal too […]

todayDecember 9, 2025 8

Sports

Nwabali Chance To Play For Afcon 2025 Dey Shakibala Cause Of Wunjuri

By: Rilwan Agbomeji Tori dey fly fly down and up  say Super Eagles keeper, Stanley Nwabali, fit miss AFCON 2025 as im still dey battle ankle and hand Wunjury. Chippa United coachie, Vusumuzi Vilakazi, na carry marras for hea dey yanyanpu  give tori pipo say,  Nwabali get wunjury. Vilakazi talk say na during Nigeria World Cup playoffs for Morocco last month e worsen di injury, and since e come back, […]

todayDecember 9, 2025 12

Sports

Guardiola Ginger Im Boys To Stay Gallant Against Real Madrid

By: Rilwan Agbomeji Pep Guardiola don warn im Man City boys ahead of Wednesday Champions League clash with Real Madrid, say Bernabeu no be playground. E talk dis one afta City beat Sunderland 3–0 for Premier League, remind everybody say Madrid no be team you dey joke with. Even though Madrid just chop 2–0 to Celta Vigo, Guardiola yarn say Bernabeu fit humble any big team wey no shine eye. […]

todayDecember 8, 2025 8

Sports

Neymar Lead Santos To Big 3–0 Win As Dem Escape Relegation.

By: Alice Iduh Santos don pull off one big miracle escape, as dem beat third-place Cruzeiro 3–0 for the last match to hold their spot for Serie A. Neymar, wey dey emotional and still dey feel pain, still show up when e matter pass. Di 33-year-old wey just come back from long knee injury na him lead di team comeback for di end of di season.

todayDecember 8, 2025 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app