Sports

674 Results / Page 38 of 75

Background

Sports

Neymar Lead Santos To Big 3–0 Win As Dem Escape Relegation.

By: Alice Iduh Santos don pull off one big miracle escape, as dem beat third-place Cruzeiro 3–0 for the last match to hold their spot for Serie A. Neymar, wey dey emotional and still dey feel pain, still show up when e matter pass. Di 33-year-old wey just come back from long knee injury na him lead di team comeback for di end of di season.

todayDecember 8, 2025 9

Sports

Liverpool Table Salah Marra Ahead Of Chapion’s Leaque

By: Alice Iduh Liverpool star mohamed salah fit miss team waka to italy for champions league match against inter on tuesday. According to reports, di club dey hold internal talk after salah yarn some strong words earlier dis week, Transfer expert, fabrizio romano post for x, coach arne slot go talk to press later today to explain wetin dey happen and go reach decision today.

todayDecember 8, 2025 26

Sports

Egypt FA Push Super Eagles Vs Pharaohs Afcon 2025 Friendly To Dec 16

By: Alice Iduh Egypt football Oga, Khaled El-Darandaly, don share update that  Super Eagles vs Pharaohs friendly no go hold for Sunday again, dem don push am go Tuesday, 16th December for Cairo International Stadium.   Oga Khaled yan tori pipo on Sunday says, dis Na because FIFA, don release new rule, that,  clubs go release players just one week before AFCON.   You sabi say  di AFCON 2025 finals […]

todayDecember 8, 2025 9

Sports

Ndidi Go Captain Super Eagles After Troost-Ekong Retirement

Wilfred Ndidi don become Super Eagles captain for AFCON 2025 afta Troost-Ekong retire. Ndidi, wey don lead Eagles for 2026 FIFA World Cup African playoffs, na now im dey front line as di most senior padi for di team. Di 28-year-old Besiktas star don make 71 appearances since 2015, and then Moses Simon go dey back am up as assistant captain.

todayDecember 5, 2025 10

Sports

Amorim Vex Say Man Utd Just Dey Waste Chances

By: Rilwan Agbomeji Manchester United boss Ruben Amorim don para after im players waste plenty chances as dem throway 1-0 lead take draw 1-1 with struggling West Ham for Premier League on Thursday. Amorim, wey dey fight to drag United comot from 8th position, blame im boys say dem no get killer instinct as dem don repeat di same wahala against Tottenham, Nottingham Forest, and even lose 1-0 to 10-man […]

todayDecember 5, 2025 8

Sports

Troost-Ekong – Wetin Make Me Retire From Super Eagles

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles Captain, William Troost-Ekong don explain why e retire ahead of 2025 AFCON. Di 32-year-old defender wey don dey carry Naija flag for almost ten years don officially waka comot on Thursday, draw curtain on im international wahala. Even though Éric Chelle put im name for di provisional AFCON list, Ekong talk say e no go follow because na now im feel say time don reach […]

todayDecember 5, 2025 15

Sports

Why We Scatter Chelsea 3-1 – Leeds Oga Daniel Farke

By: Rilwan Agbomeji Leeds United oga, Daniel Farke yarn say dem jam Chelsea 3-1 Wednesday night because im players really carry fire put show, run dem blues all over for dia house, no gree give dem chance to breathe. Farke dey shine eye as Ao Tanaka, Jaka Bijol, and Dominic Calvert-Lewin burst goals wey scatter Chelsea defense, carry Leeds run riot for Elland Road. We dey mad hungry to carry […]

todayDecember 4, 2025 13

Sports

Make Fulham Forget Man City Beating — Iwobi

By: Rilwan Agbomeji Fulham winger, Alex Iwobi don fire up im boys afta dem loose 5-4 giv Manchester City for dia own house for Tuesday. Fulham Boys no come sell groundnut ooo as dem match City fire-for-fire, push dem sotay e remain small make dem thief one point comot Pep hand. Na Iwobi even light di fire as e tear net with one mad goal afta second half pass small, […]

todayDecember 3, 2025 11

Sports

Salah Go Bounce Enter Egypt Camp Dec 15 – Slot

By Rilwan Agbomeji Liverpool oga Arne Slot don burst confirm say Mo Salah go waka comot Anfield go link up wit Egypt for AFCON on December 15. Slot drop di tori before Liverpool face Sunderland, yarn say na FIFA order say December 15 na di final day wey club must release players. Egypt sef no dey dull dia AFCON camp don open and dem get friendly match wit Nigeria on […]

todayDecember 2, 2025 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app