By: Esther Ayoola
Super Eagles coachie, Eric Chelle, don come clear im decision to close team training for three days before Nigeria play Mozambique for Africa Cup of Nations 2025 Round of 16.
Some Aproko pipo for Morocco bin dey vex say dem nor get access to di super eagles.
In fact, Photojournalist Olawale Quadri bin tuk say, rain and catarrh wan bin finish journalists, sake of say dem wan do media parley with di team but Chelle no gree dem.
Addressing dis mata on Sunday, Chelle tuk say e dey follow tournament rules and e dey important make team focus.