OBODO NAIJA

Court Grant El-Rufai ₦100m Bail

todayMay 18, 2026 5

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Justice Joyce Abdulmalik for Federal High Court for Abuja on Monday grant former Kaduna State Govo, Nasir El-Rufai, bail of ₦100 million naira.
Di judge give di ruling for Abuja say di bail come with strict conditions wey include say di surety must live for Maitama or Asokoro.
Justice Abdulmalik also order say di surety must be federal civil servant no below Grade Level 17 and must show salary evidence for at least three months, verified by bank letter.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds