By: Esther Ayoola
Federal High Court for Abuja don order Independent National Electoral Commission not to recognise or join any congress wey caretaker leaders of African Democratic Congress dey plan.
Judge Joyce Abdulmalik still talk say David Mark and some other big men for the party never still get right run package as party leaders.
Dis judgment sef don form part of di wahala inside oposition ADC.
Di case na di faction of Norman Obinna and six others carry mata go court on behalf of state chairmen and dia executives, and like dis confusion gadima for di ADC.