By: Esther Ayoola
Coventry City oga Doug King don scatta mouth say e nor dey shake about gist wey dey link coach Frank Lampard to return to Chelsea FC.
E beg fans make dem no allow rumor distract dem, say di club sti dey focus on dia long-term plan afta dia promotion to di Premier League.
Say Lampard dey run clean job for Coventry, as e carry dem win EFL Championship title and bring dem back to top flight afta many years.