Premier League news

12 Results / Page 1 of 2

Background

Sport Yarns

Manchester City Appoint Enzo Maresca As Dem New Coach To Replace Pep Guardiola

By : Jolayemi Olajide Manchester City don confirm say dem don appoint Enzo Maresca as dia new head coach, and di deal go run till June 2029. Maresca dey replace Pep Guardiola to start new levels for Etihad Stadium after the two sides agree on everything. The 45-year-old Italian coach go take over first-team work immediately and im go also join hand arrange the players wey the club go buy […]

todayMay 26, 2026 10

OBODO NAIJA

Dangote Reveal Why E No Buy Arsenal, Choose Finish $20bn Refinery Instead

By : Jolayemi Olajide Africa richest man, Aliko Dangote, don reveal say e abandon im plan to buy Arsenal F.C. because e need di money to complete im $20 billion refinery project for Lagos. Dangote make di disclosure during one podcast interview with Nicolai Tangen, where e explain say Arsenal value na around $2 billion when e seriously dey consider takeover. Di billionaire businessman talk say at dat time, e […]

todayMay 14, 2026 24

Sports

Arne Slot Konfama Say Naim Go Sti Run Matas As Liverpool Coachie Next Season

By : Jolayemi Olajide Liverpool coachie, Arne Slot, don clear air say naim go sti run parrol for Liverpool F.C. next season as dem dey prepare for 2026/27 campaign. As football journalist Fabrizio Romano report on Thursday through X, Slot tok say plans for next season don already set, and di club already don dey discuss which player dem go sign. Di Liverpool coachie talk say im dey fully involved […]

todayMay 14, 2026 16

Sports

Mainoo Sign New Man United Deal Till 2031

By: Esther Ayoola Kobbie Mainoo don sign new contract with Manchester United wey go keep am for club till 2031. Di 21-year-old midfielder wey join di academy since 2014 don already play 98 matches, even score di winning goal for 2024 FA Cup final and represent England for Euro 2024 final. Mainoo talk say Manchester United na im home and di club mean everything to im and im family. E […]

todayApril 30, 2026 10

National

Atiku Knack Alarm As Tinubu Seek $516m Loan For Sokoto–Badagry Road

By: Esther Ayoola Former Vice Presido, Atiku Abubakar don raise concern say why Presido, Bola Tinubu go send request give Senate for Abuja make dem approve $516 million external loan. Di senior man put dis for news statement on Friday wey him aide Phrank Shaibu release, U sabi say, Senate Presido Godswill Akpabio read di president loan request letter for plenary yesterday. Tinubu say im need di loan to fund […]

todayApril 24, 2026 13

Sports

How Maguire Sign New Contract With Man Utd

By: Esther Ayoola Manchester United don renew contract of dia former captain Harry Maguire, so like dis im go dey Old Trafford for at least another season. Di 33-year-old England centre-back, wey join United from Leicester for £80 million back in 2019, sign new one-year deal with option to extend further. Maguire take to im social media, express im happiness, say di tin sweet am, dat Representing Manchester United na […]

todayApril 7, 2026 18

Sports

Spurs Sack Thomas Frank Based On Bad Home Form

By: Esther Ayoola Tottenham Hotspur don sack dia manager Thomas Frank afta dem lose 2-1 for house to Newcastle on Tuesday night. Dis one dey inside Sky Sports news, di Danish coach wey join Spurs last summer from Brentford leave di club as dem dey struggle for 16th position for Premier League table, just five points above relegation zone. Spurs never win any league match for 2026 and dia home […]

todayFebruary 11, 2026 19

Sports

Chukwueze Enter Nomination For Fulham Goal Of Di Month Award

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles winger Samuel Chukwueze don get nomination for Fulham Goal of di Month award for January. Dem nominate am because of di goal wey e score for Fulham 2–1 win against Brighton, as e equalize for 72nd minute afta fine control of Joachim Andersen pass. So far, Chukwueze don record five goals and two assists from 11 league matches for di Cottagers. Di 26-year-old wey join […]

todayFebruary 5, 2026 24 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds