By: Shalom Ovie
Plenti civil society groups, trade unions, and youth omo don go mout Ikeja Under Bridge for Lagos dey shout wi nor go gree, wi nor go gree, dat insecurity, and cost of living wan kpai di living.
Di pipo pack demsef out to call on Federal Gornment say make dem consider di common man, say hunger dey di country.Dos wey dey protest, cry out say di way inflation turn turn eyes of families and business dem.
As di leaders talk, dem organize dis strong mass action to drag gornment over harsh policies wey dey format ordinary Nigerians into massive hardship.