By: Esther Ayoola
Labour Party 2023 vice-presidential candidate, Yusuf Datti Baba-Ahmed, don decide say im dey comot Labour party to join Peoples Redemption Party (PRP).
E yarn dis one for TV sit down tuk on Tuesday, where e explain say problem wan finish Labour Party.
According to am, di party don shift from wetin dem first stand for, na why e decide to comot.