OBODO NAIJA

Datti Blast Atiku

todayJune 8, 2026 10

Background
share close

Former Labour Party Vice Presidential candidate, Datti Baba-Ahmed don go shake table oh, say Atiku thinkings for politics nor enter sand, nor strong, if to say Atiku Abubakar support Peter Obi for di 2023 election, e for don win presidency for 2027.

Im yarn dis one for TV sit down tuk, say, if Atiku show patience like Tinubu and allow Obi contest first, both of dem for support am later.

Baba-Ahmed add say many politicians dey always see demsef as president too early instead of waiting for dia turn.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds