By: Esther Ayoola
Defence Minister, Gen. Christopher Musa (rtd), don comout explain wetin im experience as military head, say people conspire against am and think say dem don win, but na God intervene and lift am up.
E tuk dis one during church service for Conquerors Global Assembly for Abuja, where e go with im wife on Sunday.
Musa explain say e decide share di testimony to thank God and encourage people to trust God even when things hard.
According to am, na divine intervention and prayers help am overcome the challenges wey stand for im way to national leadership.