Sports

“Di Fixture Schedule No Fair To Man City” – Silva Yarn

todaySeptember 22, 2025 3

Background
share close

Manchester City midfielder Bernardo Silva talk say him team dey for disadvantage against Arsenal because of how Premier League take arrange di fixtures. Gabriel Martinelli score for added time to give Arsenal 1-1 draw for Emirates Stadium on Sunday. City get 66 hours to prepare for di match after dem 2-0 home win against Napoli for Champions League on Thursday. Arsenal win 2-0 against Athletic Club for Bilbao on Tuesday. “E no fair to play one of these games like this. E no correct at all,” Silva talk. “Di reality be say we no fit enter one of di most important games for di season wit dis kain disadvantage, for rest side. “I no dey feel my perfect condition to play like this, and people wey never play for highest level no sabi how e dey feel to play dis kain game. You need make your body dey your best condition.”

Manager Pep Guardiola talk say City dem “incredibly tired” against Arsenal. For January, e talk say English teams dey for disadvantage for Europe because of how Premier League dey arrange fixtures, as dem always put “the toughest schedules for the European teams for the important stages”. Silva wey make 62 appearances for City and Portugal last season talk: “I no think say dem dey try make us lose game. “E fit happen to Arsenal or Liverpool for some months time. But when you dey play Arsenal v City, or City v Liverpool, or Liverpool v Arsenal, you gats get small common sense, and understand these kain situation.”

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app