Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga, don yan how 38 churchgoers wey bandits kidnap for Eruku, Kwara State last Tuesday, take get dia freedom last Sunday, November 23. For interview wey Onanuga give Arise TV last night, November 24, e yarn say di Military and DSS join hand for di rescue. E talk say di security operatives contact di bandits and make dem release di victims. Onanuga yarn say di bandits no get choice again because dem sabi say wahala go follow if dem no obey government order.
“Dem contact di bandits to make sure say di captives go free. Security agencies get system wey dey track dis kain criminals and dem fit dey monitor wetin dey happen for real time. Dem reach out to di kidnappers, demand say make dem release di victims, and dem gree because dem sabi di consequences if dem defy government order,” na wetin e talk.