By: Esther Ayoola
One early mormor fire don scatter Elegushi Model Market for Lekki area of Lagos State, say e burn wetin nor good from about 48 shops.
Permanent Secretary of Lagos State Emergency Management Agency, Olufemi Oke-Osanyintolu, wey jump comot sleep go the area na dey confamate dis tori for statement on Sunday.
E talk say dem receive emergency call around 2 a.m., and when dem reach the place, fire don already fence the market.
According to Oke, emergency response team sha control the fire, so e no spread enter other areas wey e suppose to damage.