By: Alice Iduh
Di Economic Community of West African States, ECOWAS, Ecowas don provoke oh, declare state of emergency for all West Africa say region political and security wahala don tire dem.
Na di Commission Presido, Omar Touray, dey yan dis oneĀ on Tuesday for Abuja during di 55th Mediation and Security Council meeting.
Touray tell imĀ ministers and diplomats say recent gbege show say dem need serious thinking about di future of democracy and how to secure di community.
Im release recipt of multiple attacks wey jaguda boys don do for di area and political dramaĀ as e takeĀ turn West Africa to danger zone, and e warn say di situation go worsen if dem no act fast.