By: Esther Ayoola
Education pipo for Lagos on Thursday don clear gorment dia mind, say dem need sharp doings, inclusion, teacher training, correct data and beta action plans to build strong education system.
Dem tuk dis one for 2026 Lagos State Education Stakeholders panel wey Ministry of Basic and Secondary Education package.
Different partners like UNICEF, British Council, SKLD and New Globe show face for di programme, as dem press charge  say, teachers need beta training, and  recognition.