By: Yusuf Abuh
Naija shot put star, Chukwuebuka Enekwechi, don write im name for history book as e carry gold medal comot for men shot put event for Commonwealth Games.
Di 33-year-old bobo scatter ground as e launch better throw of 21.07 metres for im second-to-last chance for Scotstoun Stadium, and na dat one seal di gold for am.
Dis na di first time wey Nigeria go ever win gold for men shot put for Commonwealth Games.