By: Esther Ayoola
Say nor be small Fire catch for Old Terminal of Murtala Muhammed International Airport for Lagos yesterday afternoon around 3:20pm.
According to report, Federal Airports Authority of Nigeria, FAAN, and Lagos State Fire Service do beta rescue, save all 12 pipo wey di fire trap, and dem konfam say nobody die.
FAAN oga Madam Olubunmi Kuku, later clear newsmen on di update, dat, dem don start investigation to know wetin cause di fire and say, di situation dem don put under control.