OBODO NAIJA

Fake doctor wey collect N500,000 for fake UCTH job don land police net

todayJuly 22, 2026 3

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Cross River Police don arrest 39-year-old Udeme Emmanuel Ekpeme for allegedly posing as medical doctor and collecting N500,000 from one woman to help her children get job for UCTH after she report di matter.

Police tuk, tuk, ASP Sunday Eitokpah, put for statement on Tuesday for Calabar say di suspect deceive di woman by claiming say e be doctor and fit arrange di jobs.

Police say investigation show say di suspect allegedly use fake identity to collect di money from di woman.

Detectives don recover some exhibits, while di suspect still dey police custody as investigation dey continue.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds