Nigerian rapper, Folarin Falana ,AKA Falz di bad guy, sef join protesters for Ikeja Underbridge, Lagos, on Friday to demand action against rising insecurity, economic hardship and bad governance across di country.
Di protest, wey im join alongside im papa, human rights lawyer Femi Falana, and other activists, organise, pin point say enough don dey enough and dat Democracy Without Security na zero
Falz drop some bars during di protest, say, Nigerians don tire for di worsening situation and dey call on gornment leaders to protect lives and improve citizens’ welfare.