OBODO NAIJA

Federal Gornment Do Naming Ceremony For Lagos-Calabar Highway, Say Na Bola Ahmed Tinubu Coastal Highway

todayJuly 17, 2026 4

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Wi Federal Gornment don rename the Lagos-Calabar Coastal Highway as “President Bola Ahmed Tinubu Coastal Highway” to honor di presido for di project.

Di Minister of Works, David Umahi, announce dis change on Thursday inside Abuja during media briefing.

Umahi explain say di Ministry of Works take dis decision because of di long-standing vision wey oga Presido get to build di massive road project for di country.

The Minister use di powers wey he get, after he talk with him Permanent Secretary and staff of the ministry, to stamp the new name for the highway.

 

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds