Lagos

Federal Gornment To Scatta Tins To Build Gutters For Lagos Coastal Highway

todayJuly 8, 2026 10 1

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Wi Minister of Works, Dave Umahi, don spill out new plans to stop Lagos flooding for di Lagos-Calabar Coastal Highway, say dem one build new gutters.

Umahi tuk dis one meeting with stakeholders for Lagos say,  dem joinbodi with di lagos gornment build service lanes.

He explain say dis new plan na long-term arrangement to put end to di flood problem wey heavy rainfall dey always cause for di area.

But di koko be say, di minister drop warning dat dis project go touch some people, as dem go scata properties within 15 meters to di highway to make space for di new road and gutters.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds