By: Esther Ayoola
Federal Gornment don call townhall meeting for Naija pipo, both public and private sector say make everybody join bodi to build and protect di country call Nigeria.
Na Oga Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, dey tuk dis one for Naija Reputation Summit 2026 wey hapun for Abuja, wia dem take totori matas on Naija good name.
E say di launch of ogbonge movement wey dem dey call , give Naija good name, by Naija Institute of Public Relations, go hellep Show how pipo for inside and out dey see Nigera as a country.