Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Federal Government don yan say dem want make 95 percent Nigerians sabi digital work by 2030, with plan to train and empower at least 30 million people by 2027. Director-General of National Information Technology Development Agency, Kashifu Abdullahi, wey Director of Stakeholder Management, Aristotle Onumo, represent, talk dis one for Abuja during Grand Finale of Tech4Dev Digital for All Challenge 2.0. Abdullahi explain say NITDA dey push di plan through strategic partnership, especially with National Youth Service Corps (NYSC) and schools across di country. “Di DFA 2.0 competition follow NITDA vision well. Our goal na to make sure say 95 percent of Nigerians sabi digital by 2030. By 2027, we wan train and empower 30 million Nigerians. We no fit do am alone, na why we dey work with partners,” na wetin he talk. As he highlight NYSC role, Abdullahi talk say di agency dey train corpers as Digital Literacy Champions wey dem dey send go different parts of di country.
“Right now, for every local government for Nigeria, we get Digital Literacy Champions wey dey train people. Our portal too dey show live update of how many Nigerians we don train so far,” he add. He still yan say NITDA join hand with Ministry of Education and don put digital literacy inside national curriculum for all levels of education. “Recently, dem officially add digital literacy as part of curriculum for primary, secondary and tertiary schools. For Nasarawa State University, for example, dem don put digital literacy inside General Studies programme. By the time students finish their first year, Cisco go certify dem, so dem fit take part for digital economy,” he explain. NITDA oga praise Tech4Dev for their partnership, call Digital for All Challenge “shared vision”. “We believe say digital literacy na new currency for 21st century. With correct digital skills, we dey build foundation for innovation, job creation and better future. Partnership like this important because 400 NITDA staff no fit reach 270 million Nigerians alone,” na wetin he talk.
Written by: News Editor 1
DIGITAL EDUCATION DIGITAL SKILLS DEVELOPMENT Nigeria
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025