By: Esther Ayoola
Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, ni go ginger wi Super Eagles, say make dem stay focused and confident as dem prepare to face Morocco for AFCON semi-final by 9pm.
For statement wey e post for im X handle on Wednesday, di minister encourage di team and assure dem say Nigerians for home and abroad dey fully behind dem.
Idris tuk say di whole country dey stand solidly with Super Eagles as dem ready for di big match.
E also praise di team performance for di tournament, say dem don show discipline, courage and belief, wey remind Africans why Super Eagles be one of di most respected teams.