By: Ayobami Dada
Federal Controller of Works for Lagos State, Olufemi Dare, yarn on Monday say di Federal Government fit close di Lagos section of Lagos-Calabar Coastal Highway within two weeks if drivers and oda road users no obey safety rules.
Dare tok dis was as e go for inspection of di highway for Lagos on Monday, following order from Works Minister David Umahi because of safety problems, vandalism and illegal activities for di road.
He say government dey give road users two weeks to make things better, because di problems dey put people wey dey use di road at risk.
Dare say if things no improve after two weeks, government go have to close di road to protect road users and deal with di wahala