Lagos State House of Assembly don increase dia effort to stop multiple taxation and illegal collection of levies across di state.
Dis one follow report wey Chairmo, House Committee on Finance, Hon. Obafemi Saheed, present for inside plenary on Monday, 16th of November, 2026, wey Rt Honorable Speaker, Mudashiru Ajayi Obasa preside over.
Di bill wey dem title : “A Bill to Enact di Lagos State Harmonized Taxes and Levies (Approved List for Collection) Law go regulate di tax and levies wey state and local gornments fit collect.
As Hon. Saheed dey present di bill, e explain say di proposed law go wear one uniform for all approved tax and levies, stop gornment agencies from charging pipu plenty times and stop pipu wey no get authority to dey collect levies across Lagos.
Oda lawmakers kon yarn one or two things on top di bill and di speaker kon tell di chairmo say make him amend hin bill wella wella.