By: Yusuf Abuh
Federal Gornment and Lagos State Gornment don renew dia collabo doings, dis time around say na flooding dem wan rascal, to improve water management and strengthen sanitation services for residents.
Minister of Water Resources and Sanitation, Prof. Joseph Utsev, naim sorosoke dis mata as im ma go visit Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, for Lagos on Thursday, where e promise more federal support for flood control and water reforms.
Utsev say Lagos flooding dey hapun because of di water wey fence di state like body guide, fast development, climate change and heavy rainfall, say di thing be say dem need do more gutter.
Gofnor Sanwo-Olu for im part appreciate di Federal Gornment support and call for stronger cooperation to reduce climate change impact and provide beta water and sanitation services for Lagos people.