By: Esther Ayoola
Federal Gornment don put touch and candle for out side dey find means, don even lunch one ogbonge wetin dem call Nigeria National Halal Economy Strategy yesterday, business of about $7.7 trillion, and dat grow to $12 billion for Nigeria economy within di next ten years.
Oga Presido Bola Tinubu nay ni yarn dis one, sending im mouth piece, Vice Presido Kashim Shettima, for officially unveiling of di ogbonge business plan for Presidential Villa, Abuja.
Shettima say di move na strong step to diversify Nigeria exports, attract foreign investors, and create plenty jobs across different sectors of di economy.
According to Shettima, di strategy show say Naija don ready to compete for di fast-growing global halal market.