By: Esther Ayoola
Federal Government don explain say di ongoing wahala between dem and di National Association of Resident Doctors (NARD) no be because dem no care, but na structural and policy issues dey cause am.
Honourable Minister of State for Health and Social Welfare, Dr Iziaq Adekunle Salako, tuk dis on Wednesday for statement wey Statehouse release.
Im explain say Tinubu gornment still dey committed to good relation with health workers, but dem dey operate within civil service rules and national revenue limits.
Salako press tuks, say di mata nor easy, di gornment wan balance health workers’ pay demand with other national needs like education, security, and infrastructure.