By: Esther Ayoola
Minister of Housing and Urban Development, Muttaqha Darma, don drop update say federal gornment dey plan to turn informal settlements like Makoko for Lagos and Gishiri for Abuja into beta places to live.
E tuk dis one when Naija Institute of Town Planners visit am for Abuja.
Darma mention say areas for Kano and Port Harcourt sti dey among places wey need upgrade from ghetto condition.
E add say new urban development policy go focus on making sure dis communities become beta place for pipo to live well.