By: Esther Ayoola
Wi Federal Government don roll out new plan to fight mangomango for WAEC and NECO exams starting from 2026.
Di announcement drop on Monday for Abuja, as Education Minister Maruf Alausa and Minister of State Professor Suwaiba Ahmed troway di mata comout.
Dem tuk say di new move go tighten monitoring from start to finish and block every backdoor wey pipo dey use cheat for exams.
Government say di reason na to clean di system, restore trust, and make sure say Naija exam result truly reflect students’ real work and brain.