By: Esther Ayoola
Minister of Finance, Taiwo Oyedele, and Aviation Minister, Festus Keyamo, don finally meet demsevles for Abuja to tuk how dem go take solve di rising cost of aviation fuel wey dey affect airline operations.
According to Oyedele, say dem get constructive discussion on how di sharp increase in Jet A1 fuel dey push airlines under pressure and dey cause higher ticket prices.
Say dis meeting na to find ways gornment go fit take reduce di pressure on airlines, protect passengers from high fares, and build beta and sustainable aviation system for Naija.
Meanwhile, Air Peace don cut im Abuja–London flight to three times weekly because of fuel shortage, while gornment sti dey work on intervention measures dis same week to stabilize di sector.