By: Esther Ayoola
Vice Presido, Kashim Shettima don clear matas dat wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu oh, and dat im very dey serious to bring peace back to Nuku and Woro villages for Kaiama Local Gornment Area of Kwara State, afta jaguda boys wicked doings for di area.
Vice Presido dey tuk dis one on Saturday when e lead Federal Gornment delegation go sympathize with di people of Kaiama and Kwara State Governor, AbdulRahman AbdulRazaq, over di attack.
Shettima say Baba Seyi, dey vex wetin nor good, don order Nigeria Army battalion make dem deploy go Kaiama, say any jaguda boy wey dem catch wey dey involve for di badness go hear odour beta style.