Four police officers don lose dia job after dem go involve demselves  for di killing of seven traders for Owode Onirin market, Lagos, for August 2025.
Lagos State Police Commissioner, Olohundare Jimoh, na im dey align di mata give tori pipo on Thursday, say dem take part for di unlawful killings.
Jimoh explain dat, di traders dem kpai during fight wey hapun between landgrabbers and traders for Owode-Onirin area.
Jimoh say, di dismissed officers, say na from  Nasarawa dem take bring dem, by suspect ‘Ariori’, na why dem involve for di tragic killings, and  dat investigation still dey go on.