By: Esther Ayoola
Arewa and Fulani leaders don gather stakeholders address dia leadership issues say dem nor suspend Alhji Sa’adu Yusuf Dandare-Gulma as chairmo.
Fulani leader for Lagos, Alhaji Mohammad Abubakar, naim dey yan dis mata for dia stakeholders meeting wey dem run on Thursday, say, di suspension story na false and he officially cancel am, insist say Dandare-Gulma sti be chairmo.
Other leaders like Mai Kano Lawal and Alhaji Ibraheem Haruna also tuk, say di allegation no get base and na to protect unity and order for di group.
According to report, dem bring out dis statement to quash confusion and restore peace.