By: Esther Ayoola
Oga govo of Naija number one business State, Babajide Sanwo-Olu, like dis, don wire call to everybody for Africa entertainment industry make dem join hand fight piracy, fight all di oles of creative work.
Di Lagos number one man, yarn dis one for di 12th edition of Africa Magic Viewers’ Choice Awards wey selle for Lagos.
According to Sanwo-Olu, say, if dem leave all dis Creative oles, dem go spoil business for filmmakers.
E sha charge di actors, producers, directors and other creatives to dey careful dat, talent and hard work no get meaning if dem nor fit chop di benefit.