Ondo State Govo, Lucky Aiyedatiwa, don call on politicians across Nigeria make dem give more women chance for political and elective positions.
Aiyedatiwa tok dis one on Wednesday during di launch of di 774 Explode Project for Akure, Ondo State capital.
E say women dey important to national development and add say im administration dey run government wey include everybody, both men and women.
Dis 774 explode project na women empowerment programme wey di National Women Leader of APC, Dr. Mary Alile Idele start and di govo hail her for dis project.