By: Esther Ayoola
For Security matas, Plateau State Govo, Caleb Mutfwang, don go promise say im government go continue to maintain peace, improve security and push development for im state.
Mutfwang tuk dis one on Tuesday when Chief of Army Staff, Lieutenant General Waidi Shaibu, visit am for New Government House, Little Rayfield, Jos.
Di Plateau govo nor waste time, praise Naija Army and other security agencies for dia strength, professionalism and sacrifice as dem dey tackle security wahala for Plateau and Naija as a whole.