National

HEDA Carry Oyo N30bn Matter Go EFCC

todayJanuary 19, 2026

Background
share close

By: Esther Ayoola

Di Human and Environmental Development Agenda (HEDA) don carry mata go Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) over how Oyo State use N30bn wey Federal Government release afta Bodija explosion for January 2024.

HEDA tell aproko pipo on Sunday, say dem dey fear say di money for compensation, reconstruction, and emergency relief no enter wia e suppose enter.

According to HEDA, only about N4.5bn of di fund don reach victims, while di rest of di money dey mia.

Dem dey ask EFCC make dem investigate who divert or misuse di N30bn.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app