By: Mariam Ajayi
Lagos Federal High Court Judge, Justice Friday Ogazi, just give NDLEA hot query make dem carry body bring social media big boy KC Luxury, come face court after dem suuk am for cell for 14 solid days like garri inside water without even charging am to any crime.
AS KC Luxury lawyer wire the court ex parte motion, na so Baba Judge, come tell the drug officers make dem use five days explain why dem hold person pikin tight like village masquerade secret.
According by Afolabi papa, na August 13 security operatives block KC luxury for Murtala Muhammed Airport as hin dey form fine boy wan fly go Paris, but since that day, nobody tell am weda na crime or na jazz e do.
Hin say Dis one na pure oppression and dat e nor go gree.