Lagos

How Eko Strike Force Recover 111 Guns for Lagos

todayMarch 10, 2026 2

Background
share close

Eko Strike Force say dem don recover not fewer than 111 different firearms from different parts of Lagos State within di last one year.

Oga Commissioner of police, Olohundare Jimoh  ni dey conversate dis one, on Monday during di commissioning of di unit headquarters for Eko Strike Force for Soomolu.

Di police boss say di unit sef go hellep  support di work of di Rapid Response Squad to rascal jaguda for di state.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app