By: Rilwan Agbomeji
Kogi State Govo, Usman Ododo, dey vex wetin nor good say im nor wan use im two korokoro eyes see any jaguda for im state, so like dis im don order make security go pull down all terrorist hideouts for Okene Local Govment Area, say like dis security pipo don buy waka  destroy one suspected ISWAP camp for Sambel, Idoji.
As security sources tuk, say extremist activities dey increase for di area every day.
State Govment don promise say dem no go rest until dem completely flush out all criminals to bring permanent peace and stability to Kogi State.