Lagos

IGP Arrange New Police Commissioner For Lagos

todayMarch 25, 2026 13

Background
share close

Ogbonge report from police headquarters Abuja, say Lagos state don get new Commissioner of Police after dem promote some senior officers.

According to oga inspector general of police Olatunji Disu, CP Fatai Tijani go now be Lagos police commissioner, taking over from CP Olohundare Moshood Jimoh wey don become Assistant Inspector-General of Police.

Say AIG Jimoh na im go dey  lead Zone 2 Command wey cover Lagos and Ogun states.

For di new commissioner of police of lagos, CP Tijani, get plenty experience, e don serve as Deputy Commissioner for Operations for Lagos before, Area C Commander, and CP for Eastern Port Command for Rivers State.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Lagos

Lagos Police Clear False Alarm Say Area Dey Free From Cult Operations

Lagos State Police Command don clear air on di rumour wey fly say cultist wan test dia power for Shitta, Akerele, Itire/Aguda and Ishaga  area, say di report na false alarm. Dis one di police put for statement wey di police tuk tuk person, PRO Abimbola Adebisi release to tori […]

todayApril 13, 2026 2


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app