POLICE

15 Results / Page 1 of 2

Background

south west

Governor Adeleke ask Police to Commot Security for APC Local Gofnor Chairmen

  By : Jolayemi Olajide Osun State Governor, Ademola Adeleke, don tell the Inspector General of Police make e order im men to commot security personnel from di local gofnment chairmen wey belong to APC. Baba govo, Adeleke sorosoke dis one for Osogbo, as im ma dey touch light di Federal High Court judgement wey throway im party Accord Party and five others through window. After di judgement, na so […]

todayJune 16, 2026 6

Local

Anambra Police Nab Man Weh Kill Him Girlfriend

Anambra State Police don arrest 33-year-old man, Ifechukwu Okechukwu, for allegedly kill him 23-year-old girlfriend and bury her body secretly for Nkpor. Police spokesman, SP Tochukwu Ikenga, say, di arrest hapun after trending videos and information from concerned members of di public reach dem. Ikenga also say police intercept video of exhumed corpse for Nkpor and another one of 10-year-old boy wey get serious body injuries. He add say four […]

todayJune 16, 2026 8

Lagos

Lagos Police To Arrest Cars

Lagos State Police Command don announce say dem go start statewide jogolo against motors wey get covered, fake, defaced or no plate number to improve security and reduce crime. Police tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, talk say di order come from Inspector-General of Police, Olatunji Disu, and e go start on Monday, June 15, 2026, under CP Tijani Fatai supervision. To tell u how di mata serious reach, commissioner of […]

todayJune 15, 2026 7 1

foreign

Gunmen Kpai 12 For South Africa

Nor be small jogolo for South Africa, say 12 pipo don kpai after gunmen attack one small community, midnight on Tuesday. Police say about 10 attackers naim run dis package, enter different sides and begin shoot residents ratata for different locations. Police tuk tuk woman, Colonel Dimakatso Nevhuhulwi, say di suspects escape, while investigators begin touch light wetin really play for di area

todayJune 10, 2026 10

Local

Osun Police Gbab Three Suspected Cultists

Osun State Police Command say dem don arrest three suspected cultists and political thugs during separate operations for di state. For statement wey Police Public Relations Officer, DSP Abiodun Ojelabi release on behalf of CP Ibrahim Gotan, dem identify di suspects as Adekola Olayinka Abdulazeez, Omolara Ezekiel and Babatunde Azeez. Police say dem recover dangerous weapons from dem including three English Beretta pistols, cut-to-size gun, live ammunition, cartridges, cutlasses and […]

todayJune 10, 2026 13

Lagos

Lagos Gornment Share Bulletproof Vests And Helmets

Lagos State Security Trust Fund (LSSTF) don share bulletproof vests and heavy-duty helmets give all Divisional Police Officers (DPOs), Area Commanders, and tactical squad for di state. Di LSSTF boss, Dr. Ayodele Ogunsan, naim hand over di security gear on Friday base on di order of baba govo, Babajide Sanwo-Olu to take protect di police officers as dem dey fight crime. Ogunsan say dis support na to clear doubt say […]

todayJune 8, 2026 8

Lagos

Police Catch Four Cultists

Lagos State Police Command don catch four suspected cultists and recover gun, bullets, plus jackknife during one sharp operation wey dem do for Egbeda area. Di Command tok-tok person, SP Abimbola Adebisi, naim use a yam chop mouth on Thursday tuk how police use small jet li move to go gbab dis pipo  for midnight inside Alimosho axis. Among di tins wey di police dem collect from dia hand na […]

todayJune 5, 2026 13

south west

Police Clear Air Say No Security Threat Or Panic For Ondo LGA

By: Esther Ayoola Ondo State Police Command don clear di air say no shake-up, security threat, or any bad tin inside Odigbo Local Government Area at all. Di command image-maker, DSP Abayomi Jimoh, yarn dis one inside statement on Tuesday say all di sharpman doings and security check wey dem do show say di area dey clear. Because of dis one, di Commissioner of Police for di state, Felix Ohagwu, […]

todayJune 3, 2026 7

OBODO NAIJA

Police Rescue Two-Year-Old Pikin Wey Jaguda Boys Carry for Kano

Kano State Police Command don rescue one two-year-old boy wey jaguda boys carry, dem still grab three suspects and recover ₦930,000 from di ransom wey family pay. Police tuk dis one for statement wey dem drop on Saturday, wey Police PRO Abdullahi Kiyawa sign, as e break down how di pikin take miss and how police track di matter use correct informate go bring am back. Kiyawa talk say di […]

todayApril 25, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds