By: Esther Ayoola
Di Independent National Electoral Commission don give go ahead to all political parties to start public campaign for Ekiti governorship election from Wednesday, January 21, 2026.
Resident Electoral Commissioner, Dr Bunmi Omoseyindemi, ni dey yarn dis one, say di campaign go finish midnight, June 18, 2026.
Im conversate dis one for meeting wey dem hold for Ado Ekiti, gather INEC officials and party leaders tell dem wetin dem go do for di campaign.
Oga Bunmi advise all political parties make dem behave well and keep peace while dem dey campaign.