By: Mariam Ajayi
Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, IPMAN, don talk say bringing Port Harcourt, Warri and Kaduna refineries back to work fit help reduce fuel prices for Nigeria.
IPMAN toktok pesin, Chinedu Ukadike, tok dis one during one interview with tok tok channel as debate over fuel subsidy return dey continue.
E say di best way to bring down fuel price, wey dey between N1,230 and N1,299 per litre for Abuja, na to revive di country refineries.
Ukadike add say local refining go reduce dependence on imported fuel and help make petrol cheaper for Nigerians.