By Esther Daniel
Iran don launch fresh attacks on US military bases for Jordan, Kuwait and Bahrain, as America still carry out overnight airstrikes on different locations inside Iran.
US military say di strikes na to weaken Iran ability to threaten ships wey dey pass through di Strait of Hormuz.
US President Donald Trump don warn Iran say make dem return to negotiation or face more military action.
But Iran top negotiator, Mohammad Bagher Ghalibaf, say Iran no go accept any agreement wey no favour di country, adding say di country’s security depend on maintaining control around di Strait of Hormuz.